YouLyric
Sign in
Sign up for free
Iya Basira
Share
Styl-Plus
What's this song about?
Generate meaning
1
This na one buka wey I dey like to go.
2
The food sweet sote e go make your mind blow, day and night iya bas how she do am I no know.
3
They think say na jazz, my broad no be so.
4
Chorus:
5
People people make una come o
6
Iya basira e don jazz me o, ooo
7
Everybody helep save me o
8
I no dey sabi chop ati my moda or my girlfriends place
9
People People make una come o
10
Iya basira e go kill me o, ooo
11
Everybody helep save me o
12
I no dey sabi chop again my moda or my girlfriends food.
13
Long throat na food go kill you-no be so, I say na food go kill you - oga mi no be so.
14
Wettin dey be say e get one day wey I say I go play go see my paddy Sunday,
15
Na so I reach there but Sunday e don high on beer luckily for me him junior broad eye e clear,
16
He say make we stroll to the area, little did I knw that I was strolling to my burial.
17
Right there were oshodi bus dey load was a little buka close to the mainroad.
18
I laf when e pass the door, e tell me say hin name na Iya bas for short but I bow when e order,
19
Iwesiatewa, ero mm purewater not even mineral. I come gree say I go manage to chop am
20
Before I realize I dey order 2nd round, 3rd round, 4th round, I never still stop
21
Wetting iya basira e give me chop?
22
Repeat chorus.
23
Long throat, na food go kill you, na food go kill you.
24
Oga mi, you think say na play when I say na the way wey I dey, e no day ok
25
Wetting be your own advice, I don dey steal my paddy money to buy iya basira rice.
26
Even on my girlfriend birthday when she dey wait make I take am to ocean view,
27
I no know when I pass the place, the only thing wey dey my mind na Iya basira palm oil stew
28
Ah! Kilon kilon shele shele me I never see this kind juju, telle telle
29
All those wey go vex kpele kpele, but I hear say Iya basira na.......
30
I sure say still I go go there go sidon, order my first round move
31
To 2nd round, 3rd round 4th round I no dey ever stop wetting iya basira come give me chop?
32
Repeat chorus.
33
Officer abeggi follow me to the palce, everybody don telli me I dey craze
34
My girlfriend don leave me my moda no gree see me my paddy ah! Iya basira e don kill me. (x2)
35
Oya people, people make una stop officer e don come
36
Where the woman, hin dey inside, (oga I dey come)
37
Woman na wetting you dey give people chop wey dey cause all this wahala casala, oya make we talk
38
Oga sir true to God, nothing wey I dey put for the food wey I dey cook, na God dey make am good.
39
Na which kind talk be that, say na God dey cook the food abi you think say I be fool no be juju you dey put,
40
Infact I dey suspect say na.... You wash put sote people dey queue come dey rush for your stew,
41
Well to confirm am bring am make I chop small. Give me fufu 90 naira plus that soup wey dey draw.
42
Chaii correct this food sweet no be small shey una no go vex if I still order for more.
43
Officer no worry na the food be this
44
Oya people, people make una go, case dismiss.
45
Repeat chorus 2 times.
15 views
0 meanings
Go Pro
Unlimited meanings ยท Priority generation
Upgrade